This is owa Naija 
See as them the look us 
We look mad or we dey mad?
How come we get plenty but dey
like this ?
Even the one thin we been get don
the waka: PEACE 
See as everyone dey fear and the
run with plenty IDP camp
E go better Na our song 
yeah our song 
We no go give up for us 
So today ma, we go dance 
We are Nigeria and we go push our
kokomoto for beta tomorrow  
Them dey chop our money 
Yes, with pen and paper 
Them dey fuel fight sef but wetin
we know !
Na our Nigeria ,We die here e go
beta 
We dey together do beta 
If we no celebrate, wetin we gain 
But see Oga at the top, we want
beta life for our country 
Naija carry better, make una jus
work make e reach everyone 
Make we chop, we children go
school 
Make we get beta road and hospital
wen person sick 
Na too mush we ask?
We don the old oh 
Jungle don suppose mature pass
like this 
Make we buid for we children 
Make we ma make 
Them no dey collect N20 again oh,
them don old too now na N50 and above 
Them the beat people like cow come
even lock them sef 
But we get power? Even the ones
wey our thumb carry come we get ?
Even those ones with salary wey
get potbelly 
We fit question them 
Kai ! We don suffer 
Our matter plenty 
We be strong people with plenty
gifts 
We go push but kai make the 4
years come go 
We 60 years show, make e beta for
every naija person 
As e the hot !!!
Nigeria @59 
Sontyo Jimin 
30.9.2019

 
 
